- Topic
`Di parents of di 11-year-old JSS1 student of Deeper Life High School Uyo, wey bin allegedly dey sexually molested, don demand di sum of N100million compensation for di inhuman torture dia son suffer for di school.
Dis informate dey for letter dem send to di Principal of di school, through dia lawyers, Eagle-Eyes Network Chambers, wey one David Okokon sign.
Dem also demand make di school publish unreserved apology for two National Newspapers and any oda two local newspapers wey dey circulate within Akwa Ibom State and its environs.
Di school neva respond to dis latest demand.
You must be logged in to reply to this topic.